Tuesday, 4 November 2014

Co-join twins born in Sapale Hospital, die within 2 minutes - See Photos


Just received this email, will post it exactly
the way it was sent to me. Hope some of
you know how to read pidgin English. This is

so sad. Read below…

If i dey insult and yab our
Government,many people go feel
say,i dey carry yarn,becos maybe
dem dey benefit from the
Government,so dem nor wan hear
any wrong thing about the
Government.
The parents of this wonderful kids
don get other Children but d
woman dey find Girl pikin. Na so
God come throway two Girls give
her according to SCAN wey she do.
After many hours for Labour for
Sapele General Hospital. Doctors
c*m find out say if one of the child
dey push come out,say something
dey drag her back dey go inside.
So them c*m prepare the Woman
for C.S.
My people before God and Man,na
“Cojoin Twins” nai d woman
produce. After them bring down
the children,nai dem contact
me,say them get major issue wey
pass them for the Hospital. Before
i reach the Hospital,i don put on
all my Transmitting machines and
CCTV camera’s. My dear people of
Sapele from the hour of
delivery,these children nor last
reach 2Minutes,before dem give
up. WATER ALMOST FINISH FOR
MY EYES. How on earth person go
carry pregnancy for 9months,only
for her to deliver wetin our Health
sector nor fit protect? Wetin c*m
be the need of the Hospital without
basic facilities? E don tey when i
dey complain say Sapele General
Hospital nor get simple Oxygen
and other facilities to meet up our
present health challenges,but
nobody dey give listening ears.
When i reach the ward to go
examine the Babies,i c*m find out
say,na Oxygen dem say,dem use
sustain the kids or else dem for die
earlier than the period wey dem
stay. If we look well for deir
pictures under,we go see
say,somebody hold oxygen dey
inter-change am for the babies to
gasp in air to survive. From dis
picture,unu go agree with me
say,na lack of equipment nai kill
dis children becos if the two kids
get deir individual Oxygen i nor
think say,dem for ever die fast at
all,if at all say dem go die for dis
tender age.
How a whole SAPELE GENERAL
HOSPITAL nor go get Oxygen?
Report reach us say our Governor
pronounce say Delivery na free for
all pregnant women,but if you
mistake enter Labour for
30minutes,the baby norva c*m
down,the wicked nurses wey dey
General go just begin dey abuse
patients,before u know,them don
refer you for C.S,and after the d
delivery dem go charge you almost
N40K. How dat one c*m take be
free?
I don dey talk am before say na
who get something nai suppose
know the value. Our Community
Leaders wey suppose use deir
influence beg Companies to donate
some of dis facilities to our
Hospital refuse to talk. Na to chop
land money nai concern unu. When
i research about Cojoin twins i c*m
find out say to separate dem dey
hard in most cases becos them
dey mostly dey share dsame
Kidney,Heart,Liver and other
human parts. Most especially
when dem gum eachother from the
Belle side. But dem dey survive
and leave well among us. Cojoin
twins don become Minister of
Health,Engineers,Doctors and other
professioner jobs,wey contribute
deir own quarter to the betterment
of the world. Though i know say
we still dey behind to handle such
issues but the kind money wey dis
Government dey put into Health
and where as nothing dey
happen,dey very alarming. I dey
very sure say the only Oxygen wey
General Hospital manage get,nor
even dey in good working order
and nai make we quick lost this
children.
Today i dedicate this morning to
dis our priceless kids wey God use
take test our medical sector and
expose deir anus. As i call on all of
us for dis forum to pray for deir
Souls. Them deliver the children on
Friday wey pass so and dem die
dat same friday for same Sapele
General Hospital.

Source: LIB

Like This Article? Please Like Us On FACEBOOK

No comments:

Post a Comment